One big Russian amphibious ship, the Caesar Kunikov, don sink off di coast of Russian-occupied Crimea, according to Ukraine armed forces.
According to local socia media, pipo hear powerful explosions early on Wednesday, wey suggest say dem hit di landing ship for south of di town of Yalta.
Ukraine intelligence directorate release video of wetin dem say be Magura V5 sea drones as dem dey strike di ship.
Ukraine don repeatedly hit di Russian Black Sea fleet of ships for occupied Crimea.
Satellite images from last year show say plenti of di fleet don comot di peninsula go di Russian Black Sea port of Novorossiysk.
Before Nato hold dia ministerial meeting for Brussels, di secretary general, Jens Stoltenberg say Ukrainian forces don get “great victory” in recent months. E add say dem bin give “heavy losses” to di Black Sea feet wey open road so Ukraine go fit run dia grain exports.
Russia full war on Ukraine go enta im third year next week and Ukraine armed forces chief don tok say true-true, di mata dey “extremely complex and tense”.
Col Gen Oleksandr Syrskyi wey dem appoint as commander-in-chief last week, visit di front line on Wednesday and promise say e go reinforce di units wey dey try prevent Russian troops wey wan capture di flashpoint town of Avdiivka.
Di town don almost empty and na Russian forces almost surround am but one of di sojas wey dey defend am tok before say di mata dey critical.
E write for social media say, “we dey do everitin wey fit so di enemy no go fit advance deep into our territory.”
Overnight, one Russian missile attack kill three pipo wey include one pikin for di mining town of Selydove wey be 40km west of Avdiivka.
Officials say na four missiles don hit di local hospital and maternity ward plus including four blocks of flats.
Plenti odas wound for di attacks wey include pikin sef.
Confirmation neva comot from di Russian navy say di Caesar Kunikov don sink enta di Black Sea but dem just tok say dem destroy six Ukrainian drones.
BBC Verify confam say di video wey appear to show wetin happun afta di Ukrainian attack just dey uploaded recently.
Ukraine main intelligence tok for Telegram say, “Di Caesar Kunikov bin suffer critical holes to di port side and start to dey sink”.
E add say na one group called Group 13 destroy am off di Crimean coastal town of Alukpa for Ukrainian territorial waters.
Di Magura V5 unmanned drones wey dem use for di attack dey made for Ukraine according to dia manufacturers.
Amphibious ship na wetin dem dey use to move assault troops reach land sharparly especially for enemy territory.
Russia don also use dis landing ships in recent years to carry military supplies go Syria to support Bashar al-Assad goment.
Russia military bloggers no deny say dem hit di Caesar Kunikov but dem only tok say di crew survive. Russia military no dey report major losses like dat and Russians dey rely on a few popular bloggers to get information.
Di Caesar Kunikov don dey ground since di end of di Soviet era.
If dem confam di sinking, e go be di second successful strike for di Black Sea dis month. E neva reach two weeks wey one small warship wey dem dey call di Ivanovets bin sink because of drones for special operation.
Anoda Russian landing ship wey dem dey call di Novocherkassk bin dey hit for di port of Feodosiya for December.
Russia seize and annex di Crimean peninsula for Ukraine almost ten years ago and dia forces wey dem leave for dia bin play ogbonge role in dia invasion of Ukraine.
Di Caesar Kunikov don already dey targeted since di war begin. E bin dey damaged along with di Novocherkassk for one Ukrainian strike on di occupied port of Berdyansk for March 2022, wen dem sink a third landing ship, di Saratov.
Sophie Anderson, a UK-based writer, is your guide to the latest trends, viral sensations, and internet phenomena. With a finger on the pulse of digital culture, she explores what’s trending across social media and pop culture, keeping readers in the know about the latest online sensations.